Chelsea na "harmattan champion" now, na im dia coachi, Jose Mourinho tok, afta dem continue to kolobi all man, waya Liverpool 2-1 on Saturday, to keep dem ontop Premier League table.
Southampton futbal na die now sha, as dem waya Leicester City 2-kondo for house, plus Manchester United manage waya Crystal Palace 1-kondo, as dia area pipu, Manchester City play 2-2 draw wit bottom club, QPR, on Saturday evening.
De tin wey Mourinho dey fin sha, na make Chelsea be champion for May, wen dis season finish, but hin still dey jollificate for dis one wey hin carri give hinsef, sake of say dem come from back, waya Liverpool, afta Gary Cahill and Diego Costa score for dem.
"For my mind, we fit win dis league, but we, Arsenal, Manchester City, Manchester United and Southampton go still dig am. For now, we be harmattan champion," na im Mourinho tok.
"Our futbal tap well, well, bicos we wan play and we wan win. Na we play pass and na we suppose win."
Even tho Mourinho no tink say Chelsea fit copy wetin Arsenal do for 2003-2004 season, wen dem no troway any match for league, hin belle still sweet am as dem waya Liverpool.
"I no tink say we fit play de whole season, make person no waya us. E go hapun," na im hin tok.
Chelsea don gada 29 point from 11 match now, and na four point dem dey carri gap Southampton, afta dose ones win match numba 11, out of 12 wey dem don play dis season.
Shane Long bin comot from bench, wen match reach 67 minit, score two goal inside five minit, to helep Southampton kpakue Leicester.
Manchester City na defending champion, but dia ball be as e get, as dem come from back, ekwalise two tines, to follow QPR play 2-2 draw. Na Sergio Aguero score de two goal for City, to carri all de goal wey hin don score dis season, reach 12.
Charlie Austin bin fes score two tines, but refree cancel dem, bifor de guyman score QPR fes goal, as match reach 21 minit. Aguero ekwalise for City, to make scores 1-1, as match reach 32 minit, bifor QPR lead again, wen match enta 76 minit, afta City defenda, Martin Demichelis score hin own net.
Aguero come score City second goal, wen match remain seven minit to finish, but e mean say na onli two match City don fit win, out of de six wey dem don play for all competishun now.
City tanda wit 21 point now, as QPR tanda for 19 position wit eight point.
GOAL NO PLENTI
For oda match dem, goal no gree enta net sef, as Manchester United manage waya Crystal Palace 1-kondo for Old Trafford (United stadium), afta Juan Mata comot from bench, score goal, wen match reach 67 minit. United neva bin win any match from de las three wey dem bin don play.
De goal sef, dey one kin, sake of say Palace goalie, Julian Speroni, bin dey catch faya, but hin allow Mata shot enta one kin.
Mata neva even enta match reach four minit, wen hin score de ball, and he yarn amebo television pipu, Sky Sports, say United bin need de win bad.
"No be small tin. Afta three match, we bin need dis win well, well. We bin dey fin de three point and we get am. De match no easy bicos dem play well and dem for even score us sef."
FES WIN
Burnley sef, manage carri 1-kondo waya Hull City for house, afta Ashley Barnes nod ball enta net, wen match reach 50 minit, to helep dem win dia fes match dis season, since dem promote enta Premier League, from Division Two, wen season start.
Dem still dey carri las ontop league table sha, wit seven point, but dem don dey shadow QPR and Leicester now, for dat relegate area. Since dem waya Manchester United 5-3 for September 21, na onli one point Leicester don gada from dia las six match.
De match wey bin sweet pass, on Saturday, hapun for Anfield (Liverpool stadium) as Emre Can score hin fes Liverpool goal wit one helele shot from outside 18. De ball bin nack Chelsea defenda, Gary Cahill, confuse goalie, Thibaut Courtois, enta net.
Na Cahill come ekwalise for Chelsea sef, as match reach 14 minit, wit one kin gra gra goal. Na camera refree take blow wisu, say Chelsea don score, bicos e bin be like say Liverpool goalie, Simon Mignolet catch am.
Costa come settle matta, as match reach 67 minit, wen he faya one low shot enta net, but Liverpool voke well, well wen match reach 88 minit, sake of say dem bin tink say dem suppose get penarity. Steven Gerrard bin faya one coret shot wey Gary Cahill use hand touch, but refree shun.
E mean say na de third match wey Liverpool don chop beating, inside one week, be dis.
For de oda match, West Ham wey tanda for fourth ontop league table, follow Aston Villa play 0-0 draw. Villa sef, bin don chop beating for dia las six match, so dem jollificate small.
Four match go hapun on Sunday, as Arsenal go waka go play Swansea, Everton go waka go face Sunderland, Tottenham go break kola for Stoke and West Brom go try kolobi Newcastle.
No comments:
Post a Comment
drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on