Tuesday, December 2, 2014

Enyeama, Musa follo for Caf Award final five

Two Naija guymen, Vincent Enyeama and Ahmed Musa don finally make am for de list of five for de 2014 African Footballer of de Year award.
Caf don announce de five-man shortlist, and Enyeama and Musa follo de five-man list wey survive from de former 25-man list wey de bodi wey dey control all football matta for Africa bin release for November.
But as e take be, de two Naija guymen go face Ghana skippo Asamoah Gyan, Pierre-Emerick Aubameyng wey come from Gabon and de guyman wey na hin now hold de African Footballer of de year, Yaya Toure.
Caf go release de final list of three for de 2014 African Footballer of de Year bifor de Glo-Caf Awards for Lagos on 8 January.
Anoda Naija guyman wey dem bin shortlist for de African Footballer of de Year wey dey tap hin ball for Africa be Ejike Uzoenyi but hin kon no make am for de final five.
De former Enugu Rangers guyman wey hin name now dey for South African club book, Mamelodi Sundowns go only watch as de ES Setif two players, Akram Djahnit and El Hedi Belameiri go waka go face Congo's Firmin Ndombe Mubele, Fakhreddine Ben Youssef of Tunisia and late South African skippo and golee , Senzo Meyiwa.
Na de final five be dis.
•Yaya Toure (Ivory Coast & Manchester City) •Vincent Enyeama (Nigeria & LOSC Lille) •Asamoah Gyan (Ghana & Al Ain) •Pierre-Emerick Aubameyang (Gabon & Borussia Dortmund) •Ahmed Musa (Nigeria & CSKA Moscow) .

No comments:

Post a Comment

drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on