Monday, October 14, 2013

Giggs na baba


Ogbonge Manchester United winga Ryan Giggs don set anoda record lass nite for de champions League as him don tap hin 145th games for de competition.
The Welshman now don pass de record wey foma Real Madrid star, Raul bin dey take pose.
But wetin kon pain Ryan Giggs lass nite be say Man U no fit win de match bicos na 1-1 draw dem play finish with Shakhtar Donetsk.
Oga manija for Man U, David Moyes kon troway salute for Giggs for de record wey him don set.
“Beta playa don set beta record and I happy for am bicos Giggs na correct man wey dey hia word well well,”. Naso Oga Moyes tok.
Sabi strika, Robin Van Persie see two beta chance wey hin suppose take score for Man U, but de guyman miss am.
Man U fans also miss Wayne Rooney for de match as de guy wound bifor de game.

No comments:

Post a Comment

drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on