Friday, November 14, 2014

Leroy na wynch

Claude Leroy wey be Congo head coachi don yarn supersport.com on how hin take plan de win for de Diables Rouges against African champions, Naija Super Eagus for September wen de two sides germ diasef for de reverse match of de 2015 Africa Cup of Nations (Afcon) kwlifying game.
De African champions kon suffa 3-2 bulala loss for UJ Esuene stadium, Calabar on September 6 as goals from Prince Oniangue and Thievy Bifouma wey waya two goals kon dabaru de goals wey Efe Ambrose and Gbolahan Salami bin waya.
Leroy tok say na hard work wey hin do with hin squad as dem take time to study de swagger wey de Eagus get even as dem watch Eagus videos togeda and de 100-page documents wey France take bilala Naija for de round of 16 of de 2014 World Cup wey give dem betta result, as dem sabi say Naija get ogbonge players wey make dem kon work very hard to bilala de Eagus.
Leroy wey hin side sabi say de Naija Super Eagus be ogbonge side don blame de Eagus for de defeat wey dem suffa, as hin tok say na de mistake de Eagus kon make as dem waya dia early goal wen dem kon relax dat helep hin side to bilala dem 3-2.
But de Frenchman still gada plenty respect for Naija as hin bilif say Saturday game go hard well well as Naija dey enta Pointe-Noire to win de game by fire by force with ogbonge players like (Vincent) Enyeama, (Efe) Ambrose, (Ahmed) Musa and (Emmanuel) Emenike wey dia power too much, but promise say as dem work hard to bilala de Eagus afta dem don study dem bifor say naso dem go do again for Saturday match.
Congo now tanda for de secon place for Group A of de 2015 Afcon kwalifying with seven points from four matches.
Naija be third with four points from four games.

No comments:

Post a Comment

drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on