Friday, November 14, 2014

Na Equatorial Guinea get Afcon

De Confederation of African Futbol (CAF) don enta radio station on Friday announce say na for Equatorial Guinea na hin de 2015 Nations cup go now happen.
Na Morocco suppose host de competition, but de country no gree for CAF as dem dey fear de Ebola disease wey dey kill pipu for Africa.
Morocco tok say make CAF postpone de competition as dem dey fear say pipu fit carry de Ebola disease enta dia country, but CAF no gree for dem.

CAF bin don troway Equatorial Guinea kommot bifor for de preliminaries level becos of de wayo wey dem do dat time.
But CAF neva tok weda dem go allow Equatorial Guinea make dem tap ball for ness year Nations cup as de hosts countri.
Na Spanish na hin Equatorial Guinea pipu dey speak, and unna go remember say na dem and Gabon bin hosts de 2012 Nations cup wey Zambia win.
De 2015 Nations cup go start January 17, and na February 8 na hin de competiton go finish.
Naija be de current Baba for Africa, becos na dem win de 2013 Nations cup wey happen for South Africa.

No comments:

Post a Comment

drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on