Wednesday, November 26, 2014

Atletico Bilbao beat Shaktar, PSG win

Spain team Atletico Bilbao manage enta Shaktar Donetsk side for Ukraine dia beat dem 1-0 but e no solve dia wahala to take cross enta de nes stage.
Mikel San Jose gol for de secon haf na im separate de two teams from each oda wey go carri Atletico reach four point now for tabul fro Group H.
De oda teams wey dey dia group, BATE Borisov and Porto bin play dia match bifor de Shaktar and Atletico jam dia sef and na Porto take win am 3-0.
Hector Herrera fes score fo de 56 minute for de secon haf bifor Porto come show levels add anoda two gols wey Jackson Martinez and Christian Tello wey dey loan from Barcelona score for dem.
Na some of de result from Tuesday matches for Champions League be dis:
Schalke 04 0 Chelsea 5
Sporting Lisbon 3 Maribor 1
APEOL Nicosia 0 Barcelona 4
Paris Saint Germain 3 Ajax 1
CSKA Moscow 1 Roma 1
Manchester City 3 Bayern Munich 2

No comments:

Post a Comment

drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on