Thursday, November 27, 2014

No Moses till ness year

Kasala don burst for Stoke City and Supa Eagus strika, Victor Moses as de guy no go tap ball again dis year for any level.
Na de thigh injury wey hin carry for Yankee na hin pour sand for hin garri wey no go allow am play soccer.
De wound wey Moses carry na serious gbege, and e fit reach 6 weeks sef wey de guyman go take sit down for house.
Make unna no forget say na becos of dis injury na hin no make Naija coachi put hin name for de Supa Eagus playas wey jam Congo and South Africa dis month.
Assistant coachi for Stoke City, Mark Bowen yarn say de injury wey Moses carry dey pain dem for body.
“We still dey think am weda make we carry am go Chelsea make dem treat am diasef becos na dem get am, or make we dey treat am for here.
“De koko for de matta be say Moses fit no tap ball for like 6 to 8 weeks becos de injury no be small thing,” naso de coachi yarn.
Moses don tap ball 10 times for Stoke City dis season, and na onli 1 goal na hin de bobo score for dem.

No comments:

Post a Comment

drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on