Oga coachi for Chelsea, Jose Mourinho don dey troway salute for hin playas afta dem tap beta ball wey helep dem waya Schalke 04 5 kondo for dia house lass nite for champions League match.
Mourinho tok say de kain soccer wey hin boys follow Schalke 04 play sweet am well well for belle.
Na as dem start de match sef, na hin Chelsea don padlock Schalke 04 playas for inside cell, and bifor dem sabee wetin dey happen, John Terry don waya de fess goal afta juss 2 minute.
E mean say na Chelsea dey carry fess now for Group G, and de Blues don kwalify for de lass of 16 round be dat.
“Normally, if a team don score pass 3 goals for inside one match, de defendas fit dey smoke ciga near petrol, but my boys no gree open dia yans and na hin dey make me dey jolly becos dem strong kakaraka,”.
Chelsea neva chop koboko dis season for any level, and de 5 kondo wey dem waya Schalke lass nite na hin go be dia 19 games wey be unbeaten for dis season.
De match also kon dey make plenty Chelsea fans dey remember de 5 kondo wey dem waya Galatasaray for de year 1999 also for champions League match.
Schalke coachi, Di Matteo na hin helep Chelsea carry de champions League trophy for de year 2012, but de man no happy for wetin de club wey sack am lass 2 years kon do am for hin new club.
No comments:
Post a Comment
drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on