Liverpool strika, Mario Balotelli, don gree ansa de warrant wey FA for England give am, say hin bin cuss pipu one kin, ontop internet, na im amebo pipu yarn on Friday.
Balotelli bin vex pipu las week, wen hin put one piksure of one computer game, Super Mario, ontop internet.
Unda de piksure, Balotelli come rite say: "No dey cuss pipu anyhow. Resembu Mario. Hin be plumber from Italo, wey guymen for Japan make. Hin dey tok English, resembu Mexico pipu, sabi jump like black man, come like pepper like Jew."
De tin vex FA oga dem and dem say 'De cuss too heavy', de way dem bin rite am for Futbal rule E3(2), sake of say he cuss pipu wit dia colour, dia language, dia area, de way dem dey carri pray and dia God sef.
Balotelli don reach 24 years now, but hin tok say hin no go wan follow FA oga dem yarn, face to face, but hin don carri biro rite ontop paper, to beg dem, so dat dem no gi give am red card.
If anybodi carri mout cuss persin colour ontop fild, na red card for five match, strait, but dis Balotelli own no hapun for fild, so nobodi sabi de kin konk wey hin go colet.
Italo playa, Balotelli bin don tok sorry ontop internet las week, say: "Make una no vex for me. I bin wan tok say all man be de same, but e be like say I no tok am well."
Balotelli bin cancel de tin wey hin bin fes rite, but FA pipu tok say "even tho hin cancel de tin, e no mean say we no go konk am."
Since Liverpool carri 16 million pound buy Balotelli from AC Milan, wen dis season start, de bros neva fit show hin skill for there.
He neva fit score one goal for league, and dis new gbege go jus taya Liverpool pipu.
No comments:
Post a Comment
drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on