Supa Eagus midfida, John Obi Mikel don score hin fess champions League goal for hin career as de guyman dey among de playas wey score for Chelsea lass nite.
Since de year wey Mikel Obi don carry hin bag enta Chelsea, na only 4 goals na hin de Naija man don score for de Blues, but ground kon level for am again.
Na for de 56 minute na hin Mikel take score de goal for de 3-1 bilala wey Chelsea take hama Sporting Lisbon lass nite for Stamford Bridge.
Wetin kon surprise all Chelsea fans be say de coachi, Jose Mourinho start Mikel for de match wit Matic wey bin no allow Mikel to dey start match tay tay.
Foma Arsenal captain. Cesc Fabregas na hin fess score for Chelsea, and bifor Lisbon sabee wetin dey happen, Andre Schurrle don score de secon goal for de Blues afta 16 minutes.
Sporting Lisbon bin dey fite back for de match make dem score, but na de goal wey Mikel score na hin kon finish dem patapata.
De goal wey John Obi Mikel score lass nite, na hin go be hin numba 5 goal wey hin go score since 2006 wey de guy enta Chelsea.
No comments:
Post a Comment
drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on