Friday, November 21, 2014

Ancelotti dey sweat ontop Modric injury

Real Madrid coachi Carlo Ancelotti don dey scratch head how hin go take play dia La Liga match becos hin sabi Croatia midfilda Luka Modric don injure.
Madrid go jam Eibar wen lig resume from de break wey dem carri go play national team match and de yawa now be say e fit be till Janaury bifor Modric go fit tap ball again.
To jam Sami Khedira and Toni Kroos for de midfild go be de koko but again na how dem go take open space be de wahala.
"Khedira and Kroos dem na baba world champion,"Ancelotti tok for Spain radio.
"I for like make I try Isco and Kroos becos hin dey gif us beta swagga, but de wahala again dia na say we no go solid for dia."de Italo manaja yarn.
Anyone wey play dia no go matter becos Madrid go kontinu dia beta form for dis seasin agains Eibar dem wey dia budget for one year na around 20 milla for euros, and dat na de kulele wey Ronaldo alone dey kolet everi year for Madrid.
Ronaldo sef hit beta form dis seasin as hin helep Madrid grab 52 gols for all de kompitishun wey dem play dis seasin.
"I for love dis experiece die becos we stadium go full gana and to play agains all dis sabi playas na baba,"Eibar strika Mikel tok
"We mus respec dem say na one of de best team for dis world be dat but e no mean say we go fear dem,"hin add.
Afta 11 La Liga matches, Real dey front for tabul wit two points for Barca front as De Catalans go play Sevilla wey dey numba five.
Lionel Messi go get de chance to add to hin gols take break Telmo Zarra rekos of 251 gols for La Liga. Na 250 Messi don nak since October 18 wey dem play Eibar.
Atletico Madrid wey be defending champions dey four points for Madrid bak and dem go dey house play Real Sociedad wey just carri foma Manchester United manaja David Moyes to become dia coachito

No comments:

Post a Comment

drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on