Even as de Supa Eagus no gree kwalify for ness year Nations cup wey go happen for Equatorial Guinea, NFF pipu wey dey control all futbol matta for Naija neva tok anything as per de level wey Oga Stephen Keshi dey for now.
Since de day wey Keshi don return as de Supa Eagus coachi, NFF neva follow am tok hin contract matta wey hin go take work as Naija coachi.
As Naija no kwalify for de 2015 Nations cup, na hin de NFF pipu kon enta hall do dia family meeting, but wetin kon make all amebo open dia mouth yakata be say de NFF no gree say pim on Keshi matta.
De NFF kon yarn for dia family meeting say make foma Supa Eagus coachi, Shaibu Amodu resume as de NFF technical director, and na Emmanuel Ikpeme go be hin assistant.
NFF pipu also yarn say dem go send plenty Naija guymen like Amodu, Nwankwo Kanu, Garba Lawal, Yisa Shofoluwe, Austin Okocha, Ann Chiejine, Florence Omagbemi, Edema Fuludu, Dahiru Sadi, Siji Lagunju, David Ngodigha as well as five coaches from the Nigeria Professional FOotball League (NPFL), Paul Aigbogun, Kelechi Emeteole, Salisu Yusuf, John Obuh and Ladan Bosso go Yankee for beta futbol training wey go helep dem dey discover Naija playas wey sabee tap soccer.
NFF pipu also constitute on kain study group for dia meeting, and na foma Supa Eagus skippo, Austin JJ Okocha go be dia Oga patapata.
Other pipu wey dey for inside de technical study group be Benedict Akwuegbu, Celestine Babayaro, Michael Obiku, Darlington Omodiagbe, Finidi George, Taribo West, Tijani Babangida, Kashimawo Laloko, Henry Nwosu, Peter Rufai, Dominic Iorfa, Nwankwo Kanu, Dahiru Sadi, Gbenga Ogunbote, Mutiu Adepoju, Florence Omagbemi, Mercy Akide-Udoh, Ann Chiejine, Eucharia Uche, Salisu Yusuf, Alloy Agu and Benedict Iroha.
No comments:
Post a Comment
drop your comment about your football hero, their fashion style, like who dresses most, who drink most ,who hang out most like going to club , who plays with woman most and so on